Report User
Profile Photo

CHUKWU DIOffline

out of 5
0 Ratings
    • Report
      Profile picture of CHUKWU DI

      CHUKWU DI

      2 months ago ·

      Electrician Wey Recently Join Cult Because He Wan “Belong” Don KPAI Leave Him Girlfriend and Small Pikin

      Yesterday for Nnewi, Anambra State, wahala burst as cultists attack and kpai one young man wey dem dey call Chibueze. According to our source, Chibueze na electrician, and e never even too tey wey he go join cult because e wan “belong.” Now, e don belong with him ancestors.

      When our youths go wise? The day wey you join cult na the day wey you unknowingly buy your own coffin.

      The painful part be say Chibueze get small pikin with him girlfriend. Dem just recently do birthday for the pikin, now the innocent baby don lose papa. All the expenses—Pampers, milk, pap, school fees—everything don rest on the mama head alone. Society go still expect her to carry everything like say e easy.

      Ladies, shine your eyes! Before you enter relationship, do background check well. No go carry problem enter your life.

      2 Comments

    Account

    Media

    Badges Won