Report User
Profile Photo

Faithee musicOffline

5 out of 5
1 Ratings
  • Report
    Profile picture of Faithee music

    Faithee music

    3 weeks ago

    Na you carry babe for night, me I no carry.
    Na still you text me for midnight whether I fit come outside.

    I asked you; whether make I bring condoms come for you? You said NO, say something dey occur make I show for generator side.

    I asked you, whether the babe die for your house? You said NO, say make i come first.

    As I no too understand the pattern I fess carry metal with 12 rounds shook for waist, come wear man-U jersey take cover am. I meet you for gate where you wear only boxers and you dey shiver like old man wey get diabetes.

    I ask wetin sup.

    Baba tell me say him dey feel say the babe wey him carry na snake. I ask am how, wetin he mean by that. Baba say once they cuddle, e go be like say plenty hands want strangle am. Or e be like say one big round rope wan squeeze am.

    I first laugh 😂

    But this guy no dey joke. Normally na strong man for area wey boys sef dey respect. He say make i allow am sleep for my side till daybreak.

    Na my guy, I no fit loose guard am. But I just dey laugh am dey go. I ask am wetin him go tell the babe, he say him don tell am say him guy need help, say he wan go help am.

    Me I no need any help oo 😂
    Na you need help from snake.
    I come dey tease the guy say – what if the babe wan give you snake in the monkey shadow 😂

    As I dey yab am, we dey stroll go my staircase to climb up, out of nowhere – two snakes ran from generator side towards my staircase.

    I quickly pulled out my divers and off one snake, the other one run escape from backyard.

    Na so my guy and I run enter upstairs lock everywhere, lock staircase too. All those jokes wey been full my mouth clear asap.

    Strong man like me, I run enter my room go begin find the Bible wey my mama Nwanyị WATCHMAN give me many years ago wey I no dey open. Na so me and my guy – two strong men begin read Psalm 23 and Psalm 121 around 2am.

    We begin pray. My guy dey speak in tongues nai’m I burst laugh 😂😂 my guy asked me wetin sup, I ask am: baba no be this same mouth wey you use suck vajaina few hours ago nai’m you wan carry take speak in tongues? Abeg I no do again.

    When day break, my guy dey fear to enter him room, by then other neighbors don come my room, all of us waka go downstairs to my guy side. The babe done go. We no see am. She no even ask for transport or anything.

    I ask my guy where him from see this babe, he say nai’m babe wey two of them don dey run things for about 2 months. Say na from school hostel e meet am. I said no wam. I tell my compound guys make we go school hostel go find am.

    Everybody be like; “You and who?”
    #Faithee #relationship #stories

Account

My Skills

Blogging
98%
Web design
80%
Music
100%

Media

Badges Won